fbpx
May 5, 2024

Leaked audio: I no campaign for any politician – Bishop Oyedepo

oyedepo-no-campaign-for-politician

Di founder of Living Faith Church Worldwide, Bishop David Oyedepo, tok on Sunday say hin no campaign for any politician or tok on dia behalf for di build-up to di 2023 General Elections  for di Kontri.

Oyedepo tok say hin no campaign for any politician. Hin talk am for di church headquarters, Faith Tabernacle, Ota, Ogun State. Dis na in reaction to di leaked audio wey dey published by media platform.

Di leaked audio na between di cleric and di presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi. Also, di matter come out for di , for di eve of di presidential poll. Inside di audio, dem dey discuss di mobilisation of Christians for Kwara and South-West states to vote for am(Obi).

Meanwhile, di cleric, wey indirectly refer to di alleged leaked phone conversation between him and Obi, yarn san hin no follow any group of pipo tok on behalf of any politician.

FOR MORE NEWS: “Endless forgeries from APC” — Obi campaign team deny leaked audio with Oyedepo

Hin add say all political parties meet am for his prayers and advice before di election and he pray for dem.

Also, hin claim say nobody don ever tell am wetin to say for dis world.

You fit go read di tori…READ MORE