fbpx
December 22, 2024

Peter Obi don deny leaked audio call with Oyedepo, hin say he dey under pressure to leave Nigeria

peter-obi-don-deny-leaked-audio

Di Labour Party presidential candidate, Peter Obi don deny di allegations wey follow di leaked audio of Bishop Oyedepo about Christians votes.

According to di leaked audio, di ex-governor of Anambra allegedly conspire with di founder of Living Faith Church for Christian support. Also, hin claim say di election na religious war.

As Peter Obi don deny di allegations of di leaked audio, hin yarn say some pipo fabricate di audio. And dem do am to distract attention away from di APC-led government.

Inside Twitter statement, he yarn say hin go continue to protest peacefully and legally until hin stolen mandate dey returned.

FOR MORE NEWS: Sad! Electric shock Abia Electrician days to hin wife funeral

Obi yarn say di audio call wey dey circulate na fake, and say at no time throughout di campaign and now hin ever say, think, or even imply say di 2023 election na religious war.

Also, hin yarn say di attempts to manipulate Nigerians dey very sad and wicked. Ina addition, hin say dia legal team dey instructed to take appropriate legal actions against Peoples Gazette and others.

Hin yarn say make di pipo wey dey bring up heat, and wey dey create divisions, tensions and hatred within and outside Nigeria remember say Nigeria na our only country.

You fit go read di tori…READ MORE