fbpx
May 18, 2024

“He’s married” – Fan don cautions actress, Beverly Osu over comment on Aproko Doctor post

beverly-osu-comment-on-aproko-doctor-post

After actress Beverly Osu comment on influencer Aproko Doctor post, another Instagram user feel say she need to clear di actress on di influencer marital status.

As per hin custom, Aproko Doctor dey always post health awareness video on top hin Instagram page for hin followers.

When Beverly Osu post one comment, she tok off topic and instead expressed her admiration for di Doctor shirt.

“Doctor I love your shirt. I need one too @aproko_doctor… Our Aproko nation merch,” na wetin di actress write be dat.

FOR MORE NEWS: Peter Obi don deny leaked audio call with Oyedepo, hin say he dey under pressure to leave Nigeria

Replying to Beverly Osu comment on Aproko doctor post, one IG user identified as @omowumi924 clear di actress about di fact say Aproko Doctor na married man.

She write: “@beverly_osu he’s married ooooo, just want to inform you.”

Aproko Doctor wey see di comment as funny comment just laughed over am as hin ask di netizen weda she think say  Beverly Osu no dey unaware.

He write:

“Lmao. You think she doesn’t know that? You people sef.” Dis na wetin hin reply di Instagram user.

You fit go read di tori…READ MORE