fbpx
May 16, 2024

Peter Obi condemn rising insecurity for South-East, Benue, Plateau

peter-obi-react-to-rising-insecurity

Peter Obi of di Labour Party, LP, don react to di rising insecurity for di Kontri, especially for di North Central zone and di continued disruption of business and social activities for di South-East.

Obi note am say di violent attacks for di North Central states of Benue and Plateau lately don take new twist with high records of kidnapping, arson, and loss of human lives.

Also, di former Anambra State governor condemn di continued disruption of business and social activities for di South-East region over di Sit-at-Home directive wey dem yarn say e come from di Indigenous Peoples of Biafra, IPOB, even when according to am, di body bin publicly deny say dem issue such directive.

 

FOR MORE NEWS: Hushpuppi Associate, Mr Woodberry Dey Sentenced to Eight Years Imprisonment For US

 

Inside statement wey hin issue via hin verified Twitter handle on Thursday, Obi lament say di thing wey dey happen for di South-East na criminal activity and dem must find way stop am.

Also, hin yarn say various governments at all levels need to also take deliberate steps to address di issue of poverty and youth unemployment because di provision of stomach infrastructure na sure way to tackle insecurity.

You fit go read di tori see as Peter Obi react to insecurity…READ MORE