fbpx
December 23, 2024

UK Immigration arrest: I no go ever break any law knowingly – Peter Obi

peter-obi-uk-detention

Following hin detention by di United Kingdom, UK, Immigration, di Labour Party, LP, presidential candidate, Peter Obi yarn say hin no go ever break any law knowingly.

Obi make di remark as hin dey tok say hin no fear any lies and propaganda wey dey spread against am.

He top on Tuesday for di  LP National Executive Council, NEC, meeting for Asaba, Delta State

 

FOR MORE NEWS: “Dem no fit raise N10m?, Where IVD?”- Netizens Ask As Blessing CEO still dey inside jail as mentees desert her

 

According to Obi, hin dey always live hin life for di most law-abiding manner possible. Also, hin tokl say sometimes, as humans, we make mistakes, but hin  no go ever knowingly break any law.

“I am, therefore, not afraid of the lies and propaganda against my person, which are part of the journey to a New Nigeria.” Na wetin hin tok be dat.

Obi yarn say no obstacles go stop am on hin journey to ensure say a new Nigeria come.

Di former Anambra State governor charge Nigerians make dem dey steadfast and calm in di process of reclaiming dia mandate.

You fit go read di tori on Obi UK detention…READ MORE