fbpx
May 19, 2024

Police don arrest armed robbers, recover stolen items for Katsina state

Di Katsina State Police Command don arrest a gang of armed robbers who dey attack shops and residents, and robbing pipol dia belongings and other valuables things.

According to SP Gambo Isah, spokesman of di Katsina Police Command, hin tok say dem parade those suspects on Thursday,

U FIT ALSO READ 1 persin don kpai, as others woundjor as 40-ft container fall ontop 3 cars for Lagos

As nemesis don caught up with those suspects dey bin attack one residence of Aminu Alake of Kofar Guga Quarters with dangerous weapons and dey collect motorcycle, generator and other valuables things.

SP Gambo don give out di identity of di four suspects wey dey disturb di whole community. Wey dia name bi,” Umar Adamu, 20, alias Jankai, Hamza Lawal, 19, alias Show, Abubakar Isma’il, 22, and Isah Usman, 22,” all of dem na within Farin-Yaro Quarters for Katsina na hin dem dey.

Items wey dem recover from di apartment of those suspects include two big sacks, each contain armoured cables cut to size, one hacksaw, two long daggers, one pair of scissors, three big flashlights, and two mask caps among others.

Base on di same kind mata, di Katsina Police Command don also arrest one ex-convict and member of a car theft wey dey terrorise Katsina state capital.

Di suspect, Isah Mohammed, 30, of Farin-Yaro Quarters, Katsina, was caught with one motorcycle which hin later confesse say hin thieve am.

According to SP Gambo, dey don arrest di suspect previously for 2019 with one pistol for hin hand and at di same time hin dey connected with some armed robbery gang and at dat time dem carry dem go court.

To read di full tori CLICKHERE