fbpx
December 22, 2024

Police don recover three AK-47s, locally-fabricated gun from political party office for Sokoto

0
Political-party-thugs-weapon

Di Sokoto State Police Command don reveal say their operatives raid one political party office for Isa Local  Area of di state and dem recover three AK-47 rifles and a locally fabricated gun, and other dangerous weapons.

This update dey inside press statement wey dey signed and issued to newsmen for Gusau, di state capital, by di State Commissioner of Police, Mr Mohammed Usaini Gumel.

FOR MORE NEWS: 5 pipol don kpai and many don woundjor as two Cult group fight each other for Akwa-Ibom

But, di commissioner no mention di name of di political party. But, hin yarn say dem suspect say di political thugs store di weapons ahead of di 2023 political campaigns.

According to am, di police no go tolerate any form of disobedience of di law, di security agencies dey mandated to make sure say di citizens respect laws and orders for peace.

You fit go read di full tori….READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *