fbpx
May 19, 2024

5 pipol don kpai and many don woundjor as two Cult group fight each other for Akwa-Ibom

0

At least five pipol don change address go heaven and many others don woundjor as two notorious cult groups fight each other on Tuesday evening for Uyo, inside Akwa Ibom state capital.

One Eyewitnesses yarn say di fight na beetwin two cult group wey dem dey call Vikings ànd Mafians. hin tok say di fight start around 6:30 pm and he last for like two hours, bifore Police operatives and some Nigerian soldiers con show face for di area.

U FIT ALSO READ Rape: court sentence Two undergraduate student of unilorin to death

Aniekan Akpainyang, one tricycle driver, yarn tori pipol say, wetin cause di fight na very minor disagreement for one betting shop, along Ikot Ekpene road by di plaza area.

Hin tok say: “ one member of di Vikings confraternity bin place one bet of N5,000, but bo con fit pay after hin lost. So di shop attendant ask am to pay or drop hin phone, but hin con tok say lai lai hin no fit drop hin phone instead na so e call hin gang members for phone say e don set oo say make dem bring hin beret and toolz.

Dey enter di betting shop beat both di attendant at di same time raid the shop destroy things and still carry things waka comot for di shop.

Hin tok say di booking man,wey get di shop self belong to Mafians group, na so everything con turn yam pepper scatter scatter as dey don kill three pipol for di area. Dem kill two for Plaza area and one for Ikpa road junction, close to di University of Uyo (UNIUYO) town campus, dem still kill two other pipol for, Okokon Etuk street.

Police operatives, don confirm di incident yesterday, but dey never get di accurate figure of di casualty. According to Police Public Relations Officer (PPRO), SP Odiko Macdon.

To read di full tori CLICKHERE

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *