Police don rescue nine kidnap victims for Zamfara
Di Zamfara State Police Command don rescue nine kidnap victims on April 11 from Kucheri for Tsafe Local Government, Zamfara.
Also, di command spokesman, CSP Muhammad Shehu, as hin dey address journalists for Gusau say di victims, seven females, and two males, na hin dem rescue on Thursday.
Di rescue of di victims dey in sequel to di credible information wey dem get from one good samaritan. And na di information di police use successfully rescue di victims hale and hearty.
FOR MORE NEWS: “You be serial loser” – Tinubu tell Atiku
Also, hin tok say di victims undergo medical check for di police clinic for Gusau, later di police detectives free dem and dem reunited with dia families.
He reassure di general public of di command charge against di bandits and other criminal elements for di state.