fbpx
May 18, 2024

Mercy Johnson pass important message to celebrities wey dey reduce dia age

mercy-criticize-celebrities-wey-dey-reduce-age

Nollywood actress Mercy Johnson Okojie don criticize celebrities wey dey reduce or increase dia age.

Di mother-of-four post video of her outing with her youngest daughter, Divine, for Lagos park on top her Instagram page.

Inside di video, person fit see as Mercy Johnson dey encourage her daughter as she play around di bouncy house.

No matter how person reduce dia age, according to Mercy, age no dey measured in years but rather in bones.

 

FOR MORE NEWS: Police don rescue nine kidnap victims for Zamfara

 

Mercy Johnson make one point about how we fit only determine person true age through DNA as she criticize celebrities wey dey reduce and increase age.

“No matter how you reduce your age, age is not in the number ooo. Na bone e dey. From 20yrs oooo but any day you follow small pikin do race.

You go know say 40yrs bone and 20yrs bone difference dey…..so much fun plus do you believe this park is in Lagos? Will share in a bit once dem give me something”. Na wetin she tok for di video be dat.

You fit go read di tori…READ MORE