fbpx
December 22, 2024

“Pack your load comot for Lagos,no be your land” – ‘Prophet’ dey threaten Igbos wey dey live for Lagos

prophet-threaten-igbos-lagos

One Nigerian man wey identify himself as Prophet Godwin don threaten Igbos wey dey live for Lagos state sauy make dem pack dia loads comot fore dia.

Inside video wey dey make rounds online, Godwin, wey appear to be die-hard supporter of APC Presidential flagbearer, Bola Tinubu, order Igbos make dem comot for Lagos with immediate effect. Hin dey tok to di Igbos wey vote for Peter Obi for di presidential election.

As di Prophet threaten Igbos for Lagos, hin add say make churches wey support other candidates aside Tinubu follow move dia churches out of Lagos state.

FOR MORE NEWS: E no go better for anybody wey wan frustrate Nigerians! – Tacha prayer as she awaits final results from di presidential election

Na wetin hin tok be dis;

“All di Igbos for Alaba, all di Igbos for Idumota, all the Igbos for Lagos, as una wickedly vote for Obi, just pack una loads comot for  Lagos. I just dey send message across to di country.

If una play games against dis movement, make I tell you, I remain prophet Godwin

If no Asiwaju, there no go be president. Peter Obi no go be president, so una better know wetin una dey do. Na only Asiwaju fit be president of Nigeria wey go transform dis country. All di Igbos wey vote for Peter Obi for Lagos, pack your loads and leave Lagos.  All di pastors wey talk against Asiwaju for Lagos, pack your churches comot for Lagos. Lagos o be una land, leave.”

Dis threat come after Peter Obi defeat Tinubu wey be two-time governor of Lagos state, for di presidential election wey INEC conduct for Lagos state.

Meanwhile, concerned Nigerians don call for di arrest and prosecution of di self-acclaimed ‘Prophet for hin tribalistic threat.

You fit go see di full gist…READ MORE