fbpx
May 18, 2024

E no go better for anybody wey wan frustrate Nigerians! – Tacha prayer as she awaits final results from di presidential election

tacha-prayer-for-di--presidential-election

Big Brother Naija star, Anita Natacha wey dey popularly known as Tacha, don make distress prayer as she dey waiting for di results of di presidential election to dey announced.

As Nigeria draws closer to decide di next president, more celebrities don taken to social to condemn di electoral process, dis na even as dem dey hope for di best.

Di Nigerian presidential election wey happen some days ago don stir different emotions, and na wetin make Tacha drop that prayer point.

From all quarters for di country, and celebrities dey react to di process wey still dey ongoing and Tacha no dey left out.

FOR MORE NEWS: Actor Adeniyi Johnson and wife Seyi Edun don welcome twins after 7 years of waiting

Tacha share post where she express her restlessness and inability to sleep or focus on anything. She still yarn say e no go better for pipo wey dey try to frustrate di effort of Nigerians.

Na wetin she tok be this; THE WAY I KEPT ON TURNING ON MY BED ALL NIGHT! GOD! E NO GO BETTER FOR ANYONE TRYING TO FRUSTRATE NIGERIANS!! MY EYES ARE HEAVY! HEART IS HEAVY! MY TIRED IS TIRED! SINCE SATURDAY WE CONDUCTED ELECTIONS! WHERE ARE THE RESULTS?? I’M RESTLESS.

As tension still dey high everywhere, pipo still dey wait for di final result.

You fit go read di full tori…READ MORE