fbpx
December 22, 2024

Fuel price: NLC, NUJ, dey vex as frustration spread nationwide

Increase-in-pump-price-shock-nigerians

Nigerians shock on Tuesday following increase in di pump price of Premium Motor Spirit, PMS, wey dey popularly known as petrol.

According to report, anger and condemnations don pour out from across di Kontries, dis na as di citizens describe di decision as insensitive.

President Bola Ahmed Tinubu for hin inaugural address on May 29, 2023, announce an end to di fuel subsidy regime.

Even though di subsidy regime cover di month of June, oil marketers quickly adjust dia metres to N500 and above per litre of petrol.

However, less than two months after dat increment, di Nigerian National Petroleum Company, Limited, NNPCL, don announce another increment, and dem blame am on di market forces.

 

FOR MORE NEWS: Subsidy removal: Tinubu order review of N8,000 cash transfer

 

Dis matter dey come as di citizens dey battle di effects of di May 29 increment from about N197 per litre to over N500.

Many Nigerians after di aftermath of di May 29 increment park dia vehicles for house, na commercial vehicles most of dem dey use. And dis na because dem consider am to be economical. Some other pipo sell dia cars.

Prices of transportation, foodstuffs, other goods and essential services don follow witness increase.

Meanwhile, report tok say no uniform price of di commodity dey set across di kontri.

For di Nation capital, Abuja, dey sell for N617 and above, especially NNPC filling stations.

You fit go read di tori see as Pump price shock Nigerians…READ MORE