fbpx
May 11, 2024

May 29 Inauguration: Tinubu whereabout don raise controversy

questions-on-tinubu-whereabout

Ahead of di May 29 inauguration, questions on di whereabout of di President-elect, Bola Tinubu don take centre stage.

E don become normal thing for Nigeria for pipo of the upper echelon of government to keep dia health status secret even when dia na major concern for di  Kontri.

Di dark clouds over di exact nature of di illness wey leaders dey suffer, dey always lead to rumours and speculations from concerned Nigerians and members of di opposition.

Also di matter go leave dia aides, dia political parties and party chieftains with di big task of managing di huge public relations crisis wey go greet dia absence.

FOR MORE NEWS: “Mama ZEH, You are my life”- Portable celebrate hin wife, Zainab on her birthday

Nigeria don dey for dia kain situation plenty times.

For example, na so dem bin hide di illness of former President, Umaru Musa Yar’Adua, even when dem airlift am out of Nigeria for medical treatment in November 2009.

Yar’Adua bin dey suffer some kain sickness since May 29, 2007 when he become president. But dem keep di illness out of di knowledge of Nigerians. Di matter dey like that until pipo reason am say hin get kidney problems and one ailment related to heart condition.

Dis secrecy na one of di reasons why hin no formally transfer di presidential powers to hin then vice-president, Goodluck Jonathan, a situation wey spark  constitutional crisis for di Kontri.

You fit go read di tori about questions on Tinubu whereabout…READ MORE