fbpx
December 22, 2024

R Kelly dey sentence to 20 years for child sex crimes

r-kelly-sentenced-to-prison-for-child-sex-crimes

Veteran singer, Robert Kelly, wey dey known as R Kelly dey sentence to 20 years in prison for child sex crimes by federal judge. This tori dey come after jury look di matter say hin produce three videos. And di video show R. Kelly as hin dey sexually abuse hin 14-year-old goddaughter.

 

R. Kelly

Na this matter make di a federal judge sentence R Kelly to 20 years in prison for child sex crimes.

You go fit remember say di singer dey already serve 30 years after jury convict am of racketeering and sex trafficking charges.

During court, U.S. District Judge Harry Leinenweber rule say Mr. Kelly go serve nearly all of one sentence simultaneously with di previous 30-year sentence wey dem imposed last year on racketeering charges from hin Brooklyn case.

R. kelly
Di FILE PHOTO show R. Kelly as hin comot for Criminal Court Building after hin plead not guilty during  hearing on eleven new counts of criminal sexual abuse, for Chicago, Illinois, U.S., June 6, 2019. REUTERS/Daniel Acker/

FOR MORE NEWS: BREAKING: Unknown gunmen don kill Labour Party Senatorial candidate, Oyibo Chukwu for Enugu

Also, Leinenweber give order say Kelly go serve one year for prison following hin New York sentence. Federal prosecutors don argue say di 56-year-old deserve 25 years in prison on top of hin earlier sentence. Di singer’s “lack of remorse” na hin dem mention as a reason say hin fit pose danger to society if dem release am.

You fit go see di full gist…READ MORE