fbpx
December 22, 2024

Guinness World Record: Mixed reactions don follow attempts by Nigerians

mixed-reactions-as-nigerians-attempt-gwr

In a quest for fame and recognition, Nigerians don cause mixed reactions as dem dey attempt an unusual challenge to write dia names for di prestigious GWR, Guinness World Records.

Since Chef Hilda Baci from Akwa Ibom State successfully break di world record, plenty other persons don follow make attempt to break her record.

Di first na Damilola Adeparusi, (Chef Dammy) wey no ask for di Guiness World Record, GWR, permission before she start her competition.

Dammy claim say she cook for 120 hours but dem no fit verify am because at some point, she switch off live video during di contest.

With di aim of surpassing Baci 93 hours and 11 minutes record, another lady from Ondo State, Chef Deo, reveal say she don inform GWR of her intention and she don receive di green light before she start di cook-a-thon.

 

FOR MORE NEWS: “See wetin Hilda Baci don cause” – Reactions as lady, announce 200-hour sex marathon

 

Deo on Friday complete di challenge of cooking for 150 hours.

However, another plan by some persons for Ekiti to start Kiss-a-thon don equally fail as di state govt announced a ban on di activity.

Di Ekiti state government on Wednesday send strictwarning to di group wey dey plan to host di 3-day Kiss-a-thon for di State.

A statement by di Ministry of Arts, Culture and Tourism, for di State yarn say di planned event dey, unhealthy, immoral and e fit spoil di image of di State.

Also, another report tok say some persons dey plan to embark on a nationwide trekking within a time limit to set a new Guinness World Record.

Another Lady announce on top Instagram say she will go embark on a contest to be on a live video for 125 hours.

Di lady identified as Big_treshlyn wan set record for di longest instagram live video.

According to her, she go dey cook, matchmake, and play games during di video.

She don start di live video for over 24 hours.

You fit go read di tori see mixed reactions as Nigerians attempt GWR…READ MORE