fbpx
December 22, 2024

Release Nnamdi Kanu to avoid doomsday – IPOB don tell Buhari govt

release-nnamdi-kanu-ipob-don-tok

Di Indigenous People of Biafra, IPOB, on Saturday call on di President Muhammadu Buhari-led Presidency for di release dia leader Nnamdi Kanu.

IPOB spokesman, Emma Powerful, yarn say make Buhari-led Presidency release Kanu to avoid doomsday.

Powerful yarn say those ones wey dey involved in torturing Kanu using di instrument of injustice no go break wetin dey hin mind to do.

A statement by Powerful tok say di global family and movement of di Indigenous People of Biafra (IPOB) under di command of our indomitable leaders and Mazi Nnamdi Kanu dey publicly raise alarm on di worsening health condition of dia leader for di DSS solitary confinement.

 

FOR MORE NEWS: Peter Okoye don react to Achraf Hakimi divorce scandal

 

Dem tok say no matter how dem torture Mazi Nnamdi Kanu using di instrument of injustice, e no go change hin IPOB decision to demand for Biafra Independence. Di spokesman tok say lai lai, e no go ever happen.

Also, hin tok say di Nigerian government and di supporters need to understand say Mazi Nnamdi Kanu na living legend wey Biafrans no go trade with anything for dis world.

IPOB don call for Nnamdi Kanu release …READ MORE