fbpx
September 18, 2024

Mmesoma: Suspend any action – Reps tell JAMB

reps-tell-jamb-to-suspend-action

Di House of Representatives don decide to put mouth for di matter of alleged forgery of di unified tertiary matriculation examination (UTME) result by Ejikeme Mmesoma, di Reps tell JAMB to suspend any action.

Dem make dis decision on Wednesday following a motion by Awaji-Inombek Abiante on di floor of di House.

You go remember say Mmesoma, a student of Anglican Girls Secondary School for Nnewi, Anambra State and the Joint Admission and Matriculation Board (JAMB) dem go back and forth on result palava.

Mmesoma bin claim say she score 362, however, di examination body no gree, dem tok say di claim na lie, say she scored 249, and dem accuse her of forgery join.

As Abiante dey tok for hin lead debate, hin yarn say di person in question no get di opportunity to sit with dem so data dem go hear her. Also, hin tok say she fit no get di opportunity to convoke press conferences like how JAMB dey do.

 

FOR MORE NEWS: “JAMB send me text message say I score 249” — Mmesoma

 

Speaking on di motion, Idu Igaruwe, a member from Ebonyi State, fault JAMB on how dem handle di case, particularly di case of forgery.

Hin tok say JAMB dey make claim of very serious criminal offence of forgery. Forgery na felony. And then JAMB at the same time dey investigate dis allegation of forgery when presumption of innocence dey ground. Something definitely dey wrong with data process.

Following di debate on di motion, di House decide say make JAMB  suspend taking any action until investigation don conplete

Also, di House decide to set up ad hoc committee to investigate di matter.

You fit go read di tori as Reps tell JAMB to suspend action…READ MORE