fbpx
May 9, 2024

Na dangerous ID!OT Dey White House – Trump mock Biden

Donald-Trump-mock-president-biden

Former US President, Donald Trump spend part of July 4, dey mock President Joe Biden over di blunder wey hin make during hin independence speech.

U.S. President Joe Biden yarn on Tuesday say Russian President Vladimir Putin dey “lose di war for Iraq” when he suppose say Ukraine

As hin dey follow reporters tok briefly before hin comot for di White House on a trip to Chicago, dem ask Biden if Putin dey weak by di brief uprising led by a Russian mercenary chief wey dia forces dey folloe fighting against Ukraine.

According to report, Biden tok say e dey hard to tell. But Putin dey lose di war for Iraq.

“He’s losing the war at home and he has become a bit of a pariah around the world. And it’s not just NATO, it’s not just the European Union. It’s Japan, it’s 40 nations,” Na wetin hin tok be dat.

 

FOR MORE NEWS: Cameroonian defender, Ndasi don comot for Rivers United after two years

 

 

Dis na Biden second slip-up in 24 hours. On Tuesday night, Biden correct himself for campaign fundraising event – when hin refer to China instead of India, wey dia prime minister, Narendra Modi, visit di White House a week ago.

“You probably saw my new best friend – the prime minister of a little country that’s now the largest in the world, China – I mean, excuse me, India. India is not looking for a permanent alliance, but they’re looking for some hedge against – in the region,” he said.

Trump no waste time enter hin social media, blast hin rival.

“When Biden said twice that Putin is ‘losing the war in Iraq,’ everyone knew by confirmation that we have a confirmed and very dangerous idiot in the White House,” Di former president tok dis one on Tuesday afternoon on Truth social.

 

Also, hin yarn say di US no fit let dis one go on!”

In addition, hin share meme with a “F*** Biden” flag.

You fit go read di tori see gist as Trump mock President Biden…READ MORE