fbpx
May 19, 2024

SERAP threaten to sue Akpabio over senators’ holiday allowance

serap-threaten-to-sue-akpabio

Di Socio-Economic Rights and Accountability Project, SERAP, don threaten to sue di Senate President, Godswill Akpabio, over hin allege payment of holiday allowances.

Camera carry Akpabio as hin mistakenly reveal say dem don wire ‘enjoyment allowance’ to hin colleagues amid di hardship wey Nigerians dey face.

Hin bin forget say di proceeding dey captured on live camera by di Nigerian Television Authority, NTA. Akpabio tok say di pipo in charge don already send money to senators make dem enjoy dia holidays.

Also, after hin discover say hin dey on live television, Akpabio quickly withdraw di remark.

 

FOR MORE NEWS: Ogun tribunal don fix Sept 4 for final address

 

“As soon as Senator Umahi takes hin oath of office, we go rearrange di office of di leadership. To enable all of us to enjoy our holidays, a token has been sent to our various accounts by the Clerk of the National Assembly,” Na wetin Akpabio tok be dat.

Also, reacting, di group tok say dem go drag Akpabio go court for dat kain payment when Nigerians dey face severe economic hardship.

Tweeting, SERAP write: “BREAKING: We’re suing the Senate President Godswill Akpabio over the alleged payments of “holiday allowances” by the Clerk of the National Assembly into the “various accounts” of senators while some 137 million poor Nigerians face severe economic hardship.”

You fit go read di tori…READ MORE