NAIRA: No shortage of printing materials
Di Central Bank of Nigeria, CBN, don debunk claims say di Governor, Godwin Emefiele, attribute di distribution challenges of di redesigned naira notes to shortage of printing materials for di Nigerian Security Printing and Minting Company Plc (NSPM).
Also, di CBN follow yarn say di claims say Governor don threaten to close some Deposit Money Banks, DMBs na lie.
Similarly, NSPM, also known as MINT, dismiss reports of lack of capacity and non-availability of banknote substrate. Dem yarn say dem don make arrangements to continue to produce banknotes for Nigeria.
FOR MORE NEWS: Banknote crises: Shoprite, and others don start to reject old notes
Also, yesterday, di apex bank tok for circular wey dey signed by di Director of Corporate Communications, CBN, Mr. Osita Nwanisobi. Dem yarn say e no get time wey di CBN Governor announce that kain tok during hin presentation to di National Council of State for dia meeting on Friday.
According to CBN, dem yarn say dia attention dey drawn to di misleading report wey misquote di Governor, Mr. Godwin Emefiele. Di report bin talk say Emefiele attribute di current challenge in di distribution of di newly redesigned naira banknotes to a shortage of printing materials for di Nigerian Security Printing and Minting Company Plc.
In other to make di matter clear, CBN don tok say nobody tok that kain thing.
You fit go read di full tori…READ MORE