fbpx
December 22, 2024

We no date – Simi don clarify relationship with Falz

simi-clarify-relationship-with-falz

Nigerian singer Simisola Kosoko (Simi) don clarify di relationship wey she get with her colleague, Folarin Falana, a.k.a Falz.

Di songwriter yarn say she and Falz neva date before, she add say di talks about relationship with him (back then) na imaginations of dia fans.

Simi reveal di tori when dem feature her for interview segment of MTV Base Africa’s programme, Official Naija Top 10.

According to Simi, hin do verse on her song, ‘JAMB Question Remix’. And she see am say di two of dem get vibe.’

Na So dem do ‘Soldier’, and everybody kon dey feel say di chemistry between dem dey mazing.

 

FOR MORE NEWS: “Mine forever” – Temi Otedola, dey celebrate her fiance, Mr Eazi, on hin birthday

 

Di singer, wey dey married to Adekunle Kosoko, alias Adekunle Gold, or AG Baby, tok say dem no see am sef. In addition, she yarn say pipo buy wetin dem no sell.

Dem self kon see am as strategy. So, dem kon do ‘Chemistry’ album.

Also, Simi tok say pipo give dem name and idea. However, she and Falz no come out tok say dem dey date.

Di ‘Duduke’ crooner still reveal na N5,000 to N10,000 she bin dey collect as a gospel artist before she switch to secular music. You fit remember say Simi and her husband recently tease fans about dia upcoming song.

You fit go read di tori as Simi clarify her relationship with Falz…READ MORE