fbpx
June 26, 2024

Nigerian Student convert hin hostel room to big retail store inside Viral video

Student-convert- hostel-room

Another viral video dey trend. One Nigerian student convert hin hostel room to big retail store. Di viral video don cause cause plenty reactions online.

Di industrious male Nigerian student convert hin one-room hostel apartment into a retail shop where hin dey sell different type of provisions and household items too.

For inside di trending clip, dem show all di corners of di house and di kitchen. Di student don stock every where with supplies so tey di room kon resemble proper shop apart from hin bed wey bin dey for di floor of di room.

Di young man coursemates, wey visit di apartment wey turn shop, bin dey very surprised by di thing wey hin see, na hin mak am share di video online.

FOR MORE NEWS: Celebrities don attack Nedu over hin comment about BBNaija female housemates

Plenty social media users react to di trending video. Dem commend di young man as hin dey being business-oriented.

@sweet_biscuit00, “Person wey no get helper suppose be he/her own motivation cause nobody will help suffer will u. But I love the hustle ❤️may it become more successful amen”.

@mediaemenikeofficial, “This person is smart 👏 I bin get one neighbor then for my Uni hostel wey dey make noodles and eggs for us, we bin dey see her as broke student wey need to survive meanwhile na she we Dey borrow money from 😂😂😂😂 I learnt a lot from her”

You fit go read di full tori…READ MORE