fbpx
June 17, 2024

BREAKING: Tribunal don sack Adeleke as Osun governor

tribunal-sack-adeleke-as-osun-Governor-

Di Osun State Governorship Election Petition Tribunal wey dey for Osogbo don sack di Governor Ademola Adeleke as di duly elected governor of di state.

On top that matter, di tribunal don tell di Independent National Electoral Commission, INEC, make dem withdraw di Certificate of Return wey dem bin give Adeleke of di Peoples Democratic Party, PDP and,  make dem give that same certificate to di former Governor Adegboyega Oyetola of di All Progressives Congress, APC.

Additionally, di majority judgement wey di Chairman, Justice Tertse Kume read, yarn say Oyetola score di majority lawful votes of 314,931 against Adeleke’s 219,666

And now, di minority judgement still dey ongoing. Di koko now be say Tribunal don sack Adeleke as Osun governor. More details go come later…

FOR MORE NEWS: Adeleke vs Oyetola: Tribunal judgment na today, police don warn troublemakers

You go remember say INEC bin don announce Adeleke as di winner of di July 16th, 2022 governorship election.

Before di judgement start, police command don already move large numbers of security operatives across strategic points for Osogbo.

Armed police operatives follow dey for di  Osun State secretariat of the Peoples Democratic Party (PDP) and that of the All Progressives Congress (APC), as well as di state office of di APC presidential campaign for Osogbo.

You fit go read di full tori…READ MORE