fbpx
May 4, 2024

Naira scarcity: Suspend Emefiele as CBN gov – Tinubu aide dey tell Buhari

Tinubu-aide-tell-Buhari-make-hin-suspend-emefiele-as-cbn-governor

President Muhammadu Buhari don collect advise to suspend di Governor of di Central Bank of Nigeria, CBN, Godwin Emefiele.

Di Director of Media and Publicity to Bola Tinubu, di President-elect, Bayo Onanuga, make di call because of di naira scarcity wey still dey di Kontri.

Onanuga yarn say make Emefiele no suppose dey office of di CBN governor after hin scrap di cashless policy.

Inside tweet, na wetin Onanuga write be dis: “I am surprised Godwin Emefiele is still sitting pretty in office, without contrition, after he was forced to scrap his ghastly cashless policy. “President Buhari should suspend CBN Governor Emefiele from office. Emefiele should go NOW.”

FOR MORE NEWS: Guber Poll: JAMB don Shift 2023 Mock UTME To March 30

 

Di cashless policy wey CBN introduce in December 2022 don lead to di suffering of Nigerians.

Although some state governors bin contest di CBN policy in court, before di day of di presidential election.

Di Supreme Court declare say di old notes go remain legal tender till December 31, 2023.

Youfit go read di full torI…READ MORE