fbpx
September 29, 2024

Tanker explode for Lagos-Ibadan expressway, FRSC don divert traffic

tanker-explode-for-lagos-ibadan-expressway

One tanker don explode in flames following di crash for di  Ogun State area of di Lagos-Ibadan Expressway between Fidiwo bridge and Foursquare. Also, di accidents cause traffic too.

As at di time of di report, e dey reported say di unregistered tanker explode around 7:30am on Friday morning for Lagos-Ibadan Expressway.

Also, di Ogun State Federal Road Safety Corps spokesperson, Florence Okpe, confirm di incident. She add say three pipo dey involved in di accident but dem no record any death or injury.

FOR MORE NEWS: CAF Confederation Cup: Rivers United don comot go Brazzaville for Diables Noirs clash

FRSC spokesperson for Ogun, Florence Okpe, yarn say di crash involve an unregistered Daf tanker and one other vehicle.

According to her, di suspected cause of di crash na wrongful overtaking wey lead to di scratching of two vehicles, na wetin result in sparks of fire.

She quote di Sector Commander of di FRSC for Ogun, Ahmed Umar, as hin advise motorists make dem always consider weda e dey  right and safe whenever dem wan overtake.

Although di spokesperson yarn say dem contact di fire service men immediately and traffic divert. Then do all these things to avoid a secondary crash.

You fit go read di full tori…READ MORE