fbpx
December 22, 2024

“My life na testimony” – Singer Tems

Tems-journey-na-testimony

Temilade Openiyi, wey dey better known by her stage name Tems, na celebrated singer and songwriter from Nigeria wey describe her journey to fame as testimony.

Di singer yarn say although she bin start from Lagos, she don travel around di world and she tok say her life ddon serve as “testimony.”

Tems make di remarks as she dey give speech for di Essence Festival wey dey New Orleans, Louisiana.

Amid thunderous applause, na wetin she tok be dis:

 

FOR MORE NEWS: “Focus on your own life instead of my fashion choices” – Yemi Alade don slam fashion critic

 

“You know, my life is a testimony. I guess, for those who don’t understand, I’m from Lagos, Nigeria”.

Tems rise to fame after her marvelous performance as guest for Wizkid ‘Essence,’ wey bin dey included on top hin album ‘Made In Lagos, after di release of a remix version with Canadian pop star Justin Bieber in 2021.

Recall say Tems don gain international recognition ever since and she don win Grammy

Tems win Best Melodica Rap Performance for di 65th Grammy Awards on February 6, 2023 for her contribution to Future “Wait For U,” wey follow feature Drake.

With her groundbreaking achievements, Tems no only made Nigeria proud but she don become an inspiration to aspiring female musicians across di Kontri.

You fit go read di tori as Tems tok say her journey na testimony…READ MORE