fbpx
December 22, 2024

Theatre Arts Student Possess As She Dey Hold ‘Sango Sacrifice’ During Stage Play

theatre-arts-student-don-possess

A stage drama for Ekiti State University (EKSU) don take unexpected twist when one of di Theatre Arts Student possess enter another realm.

Di Theatre Art students bin dey do dia Obakoso performance during di school play and drama session when di incident happen.

One lady wey bin dey hold calabash pot for di play wey represent sacrifice for Sango (the god of thunder) suddenly enter another realm as di thing possess e.

Na so she start to twist and turn like say she lose control of herself. And immediately another person notice say something don go wrong, some men rush go di stage.

Di men quickly carry di Theatre Arts Student wey possess, comot for di stage to give room for her colleagues to continue di drama presentation.

FOR MORE NEWS: Aunty Ramota dey battle swollen belle following medication abuse

In reaction, am_fabby write; It happens na, but no matter the case the show must go on 😂😂 thespian for life

_petiteamaka; Na why I no gree do that “Iya osun” abi wetin dem call am for camp that year.. heeey Something wey I no know the origin.. and they said her river was close to the camp there 😂😂 Inukwa kee ihe m ga Akoro my mother.

sawiiiteee_; Na why them dey always pray before them start. Make person no go pack unknown spirit whilst performing

katexcel; This things happen on stage 😂.. believe it or not life is spiritual

olaedo_essentials; Omo Sango ni, she be Sango pikin. Let her go back to her roots. And yes, traditional worshippers go into trance too 🙂

chino_hendrix; This should show people to do research on our ancestors!!

queen_yong_; I thought they do pray before taking up all these demonic roles🤷. Not me sha

bk_world__; Atoh it’s well na that kind girl the spirit love she come wear red to worsen the matter 😂

You fit go read di tori…READ MORE