fbpx
April 29, 2024

I sabi say una dey vex, Tinubu yan Nigerians.

tinubu-administration-decision-dey-vex-nigerians

As Fuel subsidy removal dey frustrate,President Bola Tinubu talk on Monday say e know say some Nigerians dey vex because of some decisions wey im administration don make.

Tinubu, for im New Year address to Nigerians, yan say people dey vex because dem comot fuel subsidy and dem devalue Naira.

The President talk say, “I no dey pretend like I no know the frustration wey my people dey show, I sabi. I know say some of our people dey even ask if na like dis our administration wan give dem hope.

“For di past seven months wey we dey rule, I don make some tough but necessary decisions to save our country from serious wahala. One of those decisions na to comot fuel subsidy wey don dey disturb our country for more than four decades.

 

FOR MORE NEWS: Port Harcourt refinery don start test-run, Rivers and 11 other places go soon get supply.

 

“Another one na to comot di hold wey some few people bin get for our foreign exchange system, wey only dey benefit the rich and powerful among us. No doubt, these two decisions bring small wahala for individuals, families, and businesses.

“I dey sabi say for some time now, people don dey talk and argue about the high cost of living, inflation wey don pass 28%, and the unacceptable high rate of underemployment.”

Tinubu come talk say make Nigerians get patience as im government dey work to solve all di wahala wey dey around socio-economic situation through im ‘Renewed Hope Agenda’.

You fit go read di tori see why Tinubu administration dey vex Nigerians…READ MORE