fbpx
December 23, 2024

Easter/Ramadan: Tinubu, Wife Donate 100,000 Food Packs To Nigerians

tinubu-and-hin-wife-donate-combo-food-packs

President-elect, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu and hin wife, Senator Oluremi Tinubu don donate over 100,000 combo packs of food items to Nigerians.

Di gesture, according to dem na from di spirit of Easter celebration and Ramadan fast for both Christians and Muslims.

During di flag-off of di food distribution yesterdayfor di National Mosque, Abuja, Oluremi Tinubu wey bin dey represented by di national women leader of di All Progressives Congress (APC), Betta Edu, yarn say di idea na to show love to Nigerians.

Also, she call on pipo make dem pursue peace, security and to ensure say during dis period, Nigerians reflect and pray for di nation unity, peace, love, security and more blessings for di kontri.

She yarn say di president -elect, Senator Bola Ahmed Tinubu and di wife of di president-elect, Senator Oluremi Tinubu na hin ask dem make dem distribute combo food packs wey dem donate to Muslim faithful during di period of Ramadan. And dem do am because na period of giving and love.

FOR MORE NEWS: Jubilation as Don Jazzy bless Twitter user with N1M for accommodation

In addition, dem use di opportunity reachi out to di Christian faithful, so different churches go receive di combo packs for di Easter celebration.

Also, dem tok say dem go deliver hundreds of 1000s of di combo packs wey contain different food items to different mosques and churches across di nation…

So, dem get over 100,000 of items wey dey go out,  and de don divide am for different mosques and churches across di nation.

“Let’s pursue peace, Nigeria belongs to all of us and everyone has a role they’re supposed to play in nation building, we cannot underestimate that role, It’s time to lay aside party politics and face governance, let’s come together as one nation under God to ensure that we see the development that we wish for.  Na wetin she tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE