fbpx
December 22, 2024

Subsidy removal: Tinubu order review of N8,000 cash transfer

tinubu-direct-n8000-review

President Bola Tinubu don direct say make dem review di proposed N8000 conditional cash transfer programme wey be palliative to bring succour to most vulnerable households.

Also, di President yarn say di whole gamut of di palliative package of government to cushion di effect of subsidy removal wey don lead to di high cost of goods and services need to dey unveiled to Nigerians.

These among others bin dey contained inside statement issued by Mr. Dele Alake, Special Adviser to di President on Special Duties, Communication and Strategy for Abuja last night.

Di President according to di statement assured Nigerians say di N500 billion approved by parliament to cushion di pain wey fuel subsidy regime bring go dey judiciously utilised.

In addition, hin tok say di beneficiaries of di reliefs go be Nigerians irrespective of their ethnic, religious or political affiliation.

 

FOR MORE NEWS: “Na Difficult Journey”- Davido Adopted Son Don Graduate From University

 

According to di statement, e don become part of di culture of President Bola Ahmed Tinubu administration to constantly dialogue with Nigerians wey vote am into office.

In di last few days, di conventional and new media platforms don become awash with stories of di government wey intending to embark on conditional cash transfer to vulnerable households wey mostly dey affected by di painful but necessary decision to remove subsidy from petrol.

Also plenty tori don tok say Federal Government dey proposing to give 12 million households from di poorest of di poor N8,000 monthly for a period of six months as government palliative to reduce the discomfort wey Nigerians dey experience upon subsidy removal.

You fit go read di tori as Tinubu direct N8000 review…READ MORE