fbpx
September 29, 2024

Cash Crunch: Tinubu dey Shed ‘Crocodile Tears’ Over Nigerians’ Sufferings – Atiku

Na-tinubu-dey-cause-nigerians-sufferings-atiku-don-tok-

Di Atiku/Okowa Presidential Campaign yesterday yarn say di hoarding of new Naira notes by di Presidential Candidate of di All Progressives Congress (APC), Senator Bola Ahmed Tinubu, dey cause Nigerians unimaginable Sufferings and e dey destroy dia means of livelihood.

Hin yarn for di campaign say Tinubu dey shed crocodile tears and hin dey point accusing fingers at others.On top that one, hin dey pose himself  as champions of di pipo when na dem be di real enemies of Nigerians.

FOR MORE NEWS: New naira notes: Election riggers dey push CBN for extension — Atiku

Spokesperson, Atiku/Okowa Campaign Organization, Kola Ologbondiyan,  yarn say dem stand with Nigerians to call Tinubu and hin “co-travelers for APC” make dem end di criminal activities of intercepting and hoarding di new notes. Also hin mention say say all this things wey dem dey do, na to buy  vote.

Atiku yarn say Tinubu and hin co-workers no even mind di sufferings  and hardship wey dia evil action dey cause millions of Nigerians across di country.

In addition, Ologbondiyan yarn say di Atiku campaign dey shocked by di exposed plot by Tinubu Campaign and some APC Governors.

Those APC pipo dey plan to secretly swap N22.5 billion in old N1000 new notes for Kano as well as Lagos State where dem go get warehouse for vote buying for Tinubu campaign.

You go like read di full tori…READ MORE