fbpx
April 27, 2024

We dey work to change di tori of Nigeria – Tinubu

tinubu-to-change-nigeria-tori

President Bola Tinubu talk say e dey committed to change di tori of Nigeria for di betterment of all Nigerians.

E yan dis one as e dey brief newsmen after e don finish di rituals for di lesser Hajj, Umrah, on Sunday for Makkah, Saudi Arabia.

Also, Tinubu yan say im government dey determined to change di tori through different reforms, programs, and policies wey go finally better di citizens.

‘’The prospect of the country never reach the level wey we need am. E need hard work and consistent prayers from all of us. We don commit to use our strength to bring out dis potential for the benefit of all Nigerians.

 

FOR MORE NEWS: Russia-Ukraine conflict don cause shortage for demand of Nigeria crude – NNPCL

 

‘’For His guidance; His blessings and His answers to my prayers and the country’s prayers and for the good of all humanity. I must give thanks to God anytime I get the opportunity,’’ according to NAN wey quote am.”

You fit go read di tori as Tinubu don tok say hin dey committed to change Nigeria tori…READ MORE