fbpx
December 22, 2024

“Dis one risky, remember your pikin”, Tonto Dike 3rd liposuction don trigger reactions

Tonto-Dikeh-third-liposuction-surgery

Actress Tonto Dikeh again don undergone liposuction surgery for di third time.

Tonto make dis revelation as she share di video of her arrival for di hospital on top her Instagram page.

Also, she advise women wey no dey go gym after liposuction surgery, she said: “Finally sharing this exciting news l have aggressively tried to burn my stubborn tummy fat, but it has not been easy. After my first Lipo, I was so careless with my healing process and I lost guard on my stomach. So it grew back.

“AND I DECIDED TO GO FOR MY LIPOSUCTION AGAIN.”

Tonto Dikeh wey do her first liposuction surgery in 2017, bin reveal on top social media say she don do two surgeries, and she dey wait to do her third surgery.

 

FOR MORE NEWS: Abdul Samad Rabiu networth don skyrockets, hin be di 3rd richest man for Africa

 

Reactions don continue to trail di video wey capture di surgery process.

@sparklifeafrica: “Why you wan destroy your beautiful body? Dem no go tell you di after dangerous effects. But for di near future, you go dey run here and there. Dem just dey use you for advert”

@maggie_marg09: “Ladies, make una leave una body alone, e dey natural to get falling breast, big stomach, stretch marks, wrinkled stomach after birth. Stop to dey please society. God know why our body dey undergo these changes.”

@official_d.bae: “Make una calm down with this liposuction stuff abeg.”

@clementinaidowu: “Stella Obasanjo on my mind.”

@joynkechi51: “Abeg make una calm down. People dey die every day because of dis process; hmmm di fear of death na di beginning of wisdom.”

@pauliina_adewale: “Another Liposuction Again? Please, stop Tonto, you are already beautiful. let’s not talk sad stories about you. These repeated surgeries are so scary.”

You fit go read di tori of Tonto Dikeh third liposuction surgery …READ MORE