fbpx
March 29, 2024

Town hall meeting abi wetin dem dey call am i no go show face – Tinubu

0

Di Presidential Campaign Council of di All Progressives Congress, APC, tok say dia flag bearer, Bola Ahmed Tinubu, no go show face at all for di third edition of di presidential town hall meeting hosted by Arise Television.

Bayo Onanuga, way bi di Director, on Media & Publicity, for APC Presidential Campaign Council,na hin yarn dis one.

U FIT ALSO READ Tinubu age no be barrier – APC chieftain

Hin tok say Tinubu no go show for any town hall meeting base on di withdrawal of Peoples Democratic Party’s candidate and hin running mate, Atiku Abubakar and Governor Ifeanyi Okowa, from one town hall meeting, hosted by Original Daria Media concept, Nigerian Television Authority and MacArthur Foundation.

Bayo tok say di Presidential town hall meeting series wen bi organise by Arise TV is sschedule for 4 December 2022.

Onanuga tok say him bin dey surprise on why dem include Tinubu for di advert of di town hall meeting, without consulting him and hin aides.or seh baba Tinubu give dem di go ahead to include am for di town hall meeting.

Bayo tok say Asiwaju Tinubu too dey busy with hin campaign schedules and dat one no go permit am to honour all invitations from different radio and TV stations for debate or Town Hall meetings.

Hin tok say dia decision no bi to honour one media organisation and later ignore di others.say no bi wetin good at all.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *