Actress, Toyin Abraham don react to allege rumour of her death
Popular Nollywood actress, Toyin Abraham-Ajeyemi don take to social media to react to an allege report of her death.
Na on identified person na hin share di negative news for YouTube. Also, di person claim say na election cause di actress death.
“R.I.P Actress Toyin Abraham Death News. Clash over Naira Notes And 2023 Elections,” Na wetin di person write for di title.
As di mother of one see di false report, she yarn say di news fit dey politically motivated and na pipo wey dey oppose her political stance na hin share di video.
Toyin, wey be proud supporter of APC Presidential Candidate, Asiwaju Bola Tinubu, also condemn di act of bullying and harassing people because of dia political choice.
According to her, e no be democracy again if pipo no fit freely support di candidate of dia choice.
Speaking further, di 40-year-old movie star Toyin Abraham rebuke di news of her allege death and she still make am dem known say na Tinubu she support.
According to her post, she write:
Bullying, harassing and threatening pipo life because they disagree with you on personal choice no suppose dey encouraged at all.
Why person go put that kain thing out there? ? Why human being go dey wish others bad because dem make different choice?
Deathno be my portion in Jesus name. #asiwajubaby #iamasiwajubaby”
You fit go read di full tori…READ MORE