fbpx
May 7, 2024

September 6 no be official date: Presidential Tribunal don tok on Date To give Final Judgement

tribunal-deny-september-report

Di Presidential Election Petition Tribunal don deny di report about di trending September 6 date as di day wey dem chose to give decision on di petitions contesting President Bola Tinubu election victory.

Dis matter dey happen as Nigerians dey wait for di tribunal decision for di lawsuits wey dey against President Tinubu of di All Progressives Congress (APC) by di Labour Party (LP) and di Peoples Democratic Party (PDP), as well as dia presidential candidates Peter Obi and Atiku Abubakar, respectively, on February 25.

According to reports wey come out on Monday, di tribunal chose Wednesday, September 6 as di date to issue decision on di petitions against Tinubu Victory.

 

FOR MORE NEWS: Pete Edochie recieve double doctorate degree at 76

 

Di five-man tribunal wey Justice Haruna Simon Tsamani lead don reserve judgment and dem tok say dem soon set date to deliver di verdict to concerned parties and dia lawyers.

However, di Secretary of di PEPT panel, Barrister Josephine J. Ekperobe yarn say dem neva pick specific to deliver di ruling.

No date yet please,” na wetin Ekperobe tell di Whistler be dat.

However, report tok say di tribunal must deliver judgment on di petition on or before September 17, as di constitution give provision of a maximum of 180 days for di panel to conclude dia job.

You fit go read di tori see as Tribunal deny September report…READ MORE