fbpx
December 22, 2024

Two sons of Borno ex-commissioner, don kpai for auto crash

0
image-162

One fatal motor accident don claim di lives of two brothers wey dia name bi Adamu and Audu, di biological sons of former Commissioner of Education and Ex-Speaker Borno State House of Assembly, Hon Inuwa Kubo.

Di accident bin happun along Kwaya-Kusar- Peta- Shani road on Wednesday evening.

U FIT ALSO READ Abuja train don crash as many pipol don change address go heaven 

According to report dia car loose control con go hit head for one construction sand wey dey beside di road for where one construction company dey handle the constructing of the federal highway.

Report tok say both of dem dey go to Shani Local Government Area from Maiduguri in preparation for di campaign of the All Progressives Congress, APC. Wey go happun on Thursday and na di Deputy Governor of Borno , Umar Kadafur go launch am.

Dey don bury di two of dem according to Islamic way on Thursday afternoon.

Di State Deputy Governor, Hon. Umar Usman Kadafur don cancel di campaign rally and h8n travel with helicopter to attend di funeral prayer and to sympathize di families of di pipol wey die.

During di condolences, some pipol follow Kadafur go sympathize with di family of pipol wey die. Poppl like Senator Mohammed Ali Ndume representing Borno South, Speaker of Borno State House of Assembly, Rt.Hon.Abdulkarim Lawan, Federal lawmaker representing Gwoza, Chibok and Damboa, Hon. Ahmed Jaha Babawo, and hin counterpart representing Hawul/ Askira-UBA Federal Constituency, Hon. Dr Haruna Mshelia among others.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *