fbpx
May 19, 2024

EPL: Selling Manchester United na di best way to go – Ten Hag

0

Manchester United boss, Erik ten Hag don come out tok say di Glazer family’s decision to sell the Premier League club “Manchester United” na di best option to make di club go forward.

According to Ten Hag, hin tok say di club don give am assurance and dem believe say any change for ownership go impact di “objectives, goals and culture”. of di club.

U FIT ALSO READ Qatar 2022: Messi, Argentina na Very difficult team to play against – Griezmann

Di Glazers family, bin buy di club 17 years ago, and dey don readi to option am out to new investment or anybodi wey readi to buy am make e show face as at last month.

Di Supporters don dey call for change of ownership, since di Red Devils don fail to win any trophies give dem for di past five years now.

Ten Hag has don come out tell pipol say hin don tok with Manchester United CEO Richard Arnold say if dat kind development wey fans want go dey possibile.

Ten Hag tok say,“ E go good if dem fit sell di club in order to give room for more pipol wey dey readi to invest for di club.

Hin tok say both of dem don tok about di culture, objectives, and goals for di club and [Arnold] don promise am say nothing go change say dem go keep to wetin dem agree.

Ten Hag tok say e go dey better if dem sell di club to anoda owner becose by den more money go dey available for di club to carry out necessary projects.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *