fbpx
May 18, 2024

Brain drain: UK don put Nigeria on red list for health workers’ recruitment

uk-put-nigeria-on-di-red-list

Di United Kingdom don put Nigeria on di red list of Kontries wey no need to dey actively targeted for recruitment by health and social care employers.

Dis update dey come one month after di World Health Organisation list 55 countries, including Nigeria wey dey face di most pressing health workforce challenges related to Universal Health Coverage.

Also, di United Kingdom Government yarn say Nigeria and other Kontries wey dem put on top red list no need to dey actively targeted for recruitment by health and social care employers unless dem get government-to-government agreement.

FOR MORE NEWS: PDP deserve to lose governorship, presidential elections: Senator Ogba don tok

According to di information wey dey for di website of di UK government titled ‘Code of Practice for the international recruitment of Health and social care personnel in England,’ e tok say Kontry identification follow di methodology wey dey for di 10-year review of relevance and effectiveness of di WHO global code of practice on the International Recruitment of Health Personnel.

You fit go read di tori…READ MORE