fbpx
June 26, 2024

“Men no get business to marry before 40 because dem neva ready” – Uti Nwachukwu

uti-nwachukwu-men-marry-at-40

Nollywood actor and media personality, Uti Nwachukwu don reveal why he believe say men and women no get business to marry before di age of 40 and 30 respectively.

Uti wey still dey single share hin reasons during new interview with Toke Makinwa for ‘Toke Moments’

According to Uti, e better to take time live life and weigh your options until you dey ready to fully commit to relationship.

FOR MORE NEWS: “Why I no See Myself as Feminist”- Actress Ini Edo Don Reveal

Uti tok say na why hin neva marry yet. Hin yarn say hin fit be Kamala Harris’ age when he decide to marry.
Hin tok say hin no believe in monogamy when person dey young but exceptions dey to every rule. Although monogamy dey work for some pipo when dem dey young but di average person.
Also Uti Nwachukwu tok say to am, e no make am feel right, Men no get business to marry before 40 because dem neva ready

For women, Between 35 – 40 na hin better apart from di once wey dey fear of dia biological clock. Hin ask say how many children women want these days? And technology dey these days too. So for that reason, e no think say any woman suppose marry before 30.

According to Uti, person need to experience life as a single. Person need to weigh dia options. In addition, For am, marriage na contract between you, me, and God.
Leave contract, leave agreement. If you no wan commit to somebody, no make am official, whether for di presence of God, presence of di government, or presence of your family. Once you agree, integrity na integrity.  All these things na wetin Uti tok.

 

You fit go read di full tori…READ MORE