fbpx
April 23, 2024

Why Igbo pipol no wan support Peter Obi– Frank Edoho

0

Nigerian TV host, Frank Edoho don chook mouth on why igbo pipol no wan support di former governor of Anambra state peter obi for 2023 presidential race

Frank tok say hin shock with wetin some Igbo politicians dey do to former Anambra Governor and current Labour Party presidential candidate, Mr Peter Obi.

U FIT ALSO READ Gbasgbos: Professor Do your Own, I Don Do Mine – Peter Obi Yab Soludo

Frank, way bin dey host one Nigerian reality TV show, ‘Who wants to be a Millionaire’, yarn dis one on hin tweeter handle while reacting to di recent gbege beetwin Soludo amd Peter Obi.

Hin tok say Soludo wen bi write inside one of hin article on Monday, rubbish di presidential ambition of peter Obi, hin tok say obi lack di capacity to win di coming election.

Edoho tok say hin still dey wonder why di Igbo politicians go dey attack dia own presidential candidate,despite say opportunity don show for Igbo presidency.

Hin tok say “Igbo politicians no go ever stop to dey amaze am.Opportunity of igbo pipol to become President for nigeria don show bi dat,frank ask say why dem no fit give obi di full support just like Yoruba and Hausa pipol do dia candidates.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *