fbpx
December 22, 2024

Why DJ Cuppy fiancé, Ryan Taylor dump her – Twitter user reveal

why-ryan-call-off-engagement

One Twitter user don reveal di alleged reason why Ryan Taylor, di estranged fiance of popular entertainer and Billionaire daughter,DJ Cuppy, allegedly call off dia engagement.

Dis matter dey come amid di widespread speculations say di couple, wey engage just 25 days after dia first meeting in November 2022, don part ways.

Also, di rumor gain traction when Ryan post cryptic post say hin dey let go of anything wey go hinder hin spiritual growth, and later, hin unfollow Cuppy on top Instagram.

While di couple neva officially confirm or refute di rumors of dia breakup, di topic don generate significant attention from Nigerians on top social media.

 

FOR MORE NEWS: “Lion no dey born goat, but una sure say na Pete born Yul” – Funnybone troll Yul Edochie

 

Also, one Twitter user, identified as Dami Adenuga, don take to Twitter to reveal di alleged reason why di lovers call off dia engagement.

Dami make claims say Ryan end hin relationship with Cuppy because of allege dissatisfaction with di level of dia  sexual intimacy.

“Rumors has it that Dj cuppy’s boyfriend broke up with her because of sex 💀”, Na wetin hin tweet be dat.

Though dis claim neva dey verified, but e don spark reactions from netizens.

@keishanotkesha write, “Lmao she seems like she wouldn’t be interested in a lot of sex tbh lol she gives me live “laugh love vibes” lmaoooo corny and awkward. Not much sex appeal”

You fit go read di tori see Why Ryan call off engagement….READ MORE