fbpx
May 6, 2024

“We no go allow cows for Abuja” ― Minister of FCT, Wike vow

wike-vow-to-end-open-grazing

Di newly sworn-in Minister of di Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike don vow to end open grazing for Abuja,hin yarn say di federal government no go allow cows to parade for di city.

Also, di former governor of Rivers state as hin dey tok inside press conference for Abuja on Monday, hours after hin swearing-in yarn say di ministry go consult with herdsmen to see how dem go stop open grazing for Abuja, also, hin note am say dem plant di grasses for di city to beautify and not to feed cows.

 

FOR MORE NEWS: Churchill Olakunle don break silence on allege divorce from wife

 

Wike assume office on Monday and also hin declare say dem go remove all illegal structures wey dey obstruct building plans for di city.

Also, hin give warnings to land allottees who get Certificates of Occupancy but never develop, hin yarn say such people go lose dia lands to give way to those wey ready to build.

In addition, Wike yarn say government go reclaim all Uncompleted buildings wey don become a safe haven for criminals and dem go put di land to good use.

You fit go read di tori see why Wike vow to end open grazing…READ MORE