fbpx
April 26, 2024

Williams Ruto win Kenya presidential election

0

The person wey be Oga patapata for Kenya’s election body IEBC on Monday don declared Deputy President William Ruto as the person wey carry first in the election wey the two-contestant fought seriously to win.

As the Chairman wey dey in charge of the Independent Electoral and Boundaries Commission Wafula Chebukati said Ruto clear almost 7.18 million votes (50.49 percent) against 6.94 million (48.85 percent) wey him rival Raila Odinga pull in the August 9 vote.

Ruto go be fifth president-elect wey Kenya go get.

The announcement no quick come as some commissioner wey dey in charge of voting in some area be yarn say, dem no understand how some result take be, the matter cause small wahala before the chairman come finally announce who win the election.

As it is, some no gree with the finally result. According to the Vice Chair Julianaa Cherera, She open her mouth talk say, “We cannot take ownership of the result that will be announced”.

She talk say the process of the election been get as e take be ” but she no gree talk wetin dey her mind reach ground, as she yarn say more information go dey komot later.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *