fbpx
December 22, 2024

May 29 Inauguration: No go compromise as you dey choose your Ministers – Youths tell Tinubu

youths-advise-president-elect-make-hin-no-compromise

Ahead of di May 29 swearing-in ceremony, Nigeria youths don advise President-elect Bola Ahmed Tinubu make hin no compromise in selecting hin cabinet ministers.

Di Northern Christain Youth Professionals (NCYP) National Leader, Mr Isaac Abrak, reveal dis update on  Friday for Kaduna as hin dey salute di Muslim faithful over di Eid-el-Fitr celebration.

Abrak remind di President-elect, Bola Tinubu, say Nigerians vote for am base on hin track record as di Governor of Lagos State and dem advise am make hin no compromise hin sterling leadership quality.

 

FOR MORE NEWS: Peter Obi dey face post election battles

 

According to am, Tinubu transform Lagos into one of di biggest economies for Africa because he assemble teams of pipo wey understand hin God-given call for service to humanity.

Abrak add say di cabinet wey make up hin administration as di then-governor of Lagos be patriotic Nigerians drawn from all ethnic and religious backgrounds based on merit.

He task Tinubu say for di same vein, make hin appoint credible and competent hands to pilot di affairs in various ministries, departments and agencies.

Also, di group task di President-elect make hin dey mindful of di security and economic hardships wey dey trouble Nigerians.

You fit go read di tori as Youths advise President-elect….READ MORE