fbpx
May 18, 2024

“I’ll be back soon” – PSG Neymar don vow to return to hin former club

neymar-vow-say-hin-go-return-to-boyhood-club

Paris Saint-Germain forward, Neymar don vow say one day hin go return to hin boyhood club, Santos.

Neymar dey take care of di knee injury wey hin get. However, hin appear for Santos’ Copa Sudamericana clash with Audax Italiano on Thursday.

Also, as hin dey talk to press after di match wey hin watch from one of di club executive boxes, Neymar tell GOAL say e feel nice for am to come back to hin house.

Hin tok say hin feel at home there, and he dey so happy to be back after ten years. Unfortunately, na draw, and hin bin wan win.

FOR MORE NEWS: May 29 Inauguration: No go compromise as you dey choose your Ministers – Youths tell Tinubu

In addition, hin tok say hin go there to support Santos and receive di affection of fans.

Hin still tok say na di club give am everything, wey open doors for him and hin family, and na di club reveal am to di world.

“One day I will be back. I will be back soon.”

Neymar contract with PSG go expire in 2025 and hin fit choose to stay for di French Ligue 1 champions in an attempt to run down hin deal before heading back to Brazil as free agent.

You fit go read di tori as Neymar reveal say hin go return to boyhood club…READ MORE