fbpx
November 16, 2024

Zamfara NSCDC reunite missing boy with hin parents

zamfara-nscdc-reunite-missing-young-boy

Di Zamfara State Command of di Nigeria Security and Civil Defence Corps NSCDC don reunite one young boy, Musaddiku Muhammad, with hin biological parents for Magazu village inside Tsafe local Government Area of di state.

According to a statement by di Corps Public Relations Officer, Ikor Oche, operatives of di Corps for Bauchi State see di boy for garage when dem dey on routine patrol.

Dem tok say dem trace di boy to Zamfara State where person carry am comot from hin parents to Bauchi for Quranic Studies for place wey dem call Moroco quarters.
Later, dem kon transfer am to di office of di NSCDC Zamfara State Command for investigations on di 13th April 2023.

Preliminary investigations reveal say di boy (Musaddiku Muhammad) come from Magazu village of Tsafe local Government Area. Commandant MB Muazu later call on di Hakimi of Magazu village and di supposed parents of di boy for identifications.

However,di State Commandant, Commandant MB Muazu, advise members of di public make dem dey careful of di kind of places wey dem dey carry dia pikin go for studies.

Meanwhile, Ibrahim Maiwada, di Hakimi of Magazu village don express joy over di reunion of di pikin with his parents.

As di Zamfara NSCDC reunite di young boy with hin parents, Maiwada yarn say hin go do all within hin powers to stop any future occurrence.

You fit go read di tori…READ MORE