fbpx
May 1, 2024

Violence for Sudan: 100 pipo don kpai

100-pipo-don-die-as-fight-between-Sudan-military-and-di-paramilitary-Rapid Support-Forces-continue

At least one hundred pipo don die and plenty others get injury as fight between Sudan military and di paramilitary Rapid Support Forces, (RSF), rage on for Khartoum, di Kontri capital.

Voice of America, (VOA), report on Monday say both sides dey claim control of strategic sites, with calls for a ceasefire growing.

Di military headquarters, Khartoum international airport and areas around di presidential palace na di current main battlefields between di military and di Rapid Support Forces.

 

According to report, di clash don affect di power supply and water systems for di capital. And as e be so, di matter don make life more difficult for those wey dey trapped indoors by di fighting and pipo wey dey wounded for di clashes.

Also, di UN envoy to Sudan, Volker Perthes, yarn say more than 1,800 na hin don get injury for di fight. In addition, dem warn say plenty pipo no fit reach hospitals for medical treatment amid di clashes.

You fit go read di tori of di fight between Sudan military…READ MORE