fbpx
April 30, 2024

2023: APC fit win di election on one condition —Buhari

0

President Muhammadu Buhari, don come out tell di ruling party All Progressives Congress, APC, say na only unity fit make dem win for di 2023 general elections.

Oga Presido tok say both unity and cooperation with one another na di key to victory for di coming elections.

U FIT ALSO READ Obi boast to win for S/West, as hin show face for Ibadan

President Buhari yarn dis one for Daura on Friday wen hin receive Dr Dikko Radda, di governorship candidate of di APC and Faruk Lawal Jobe, di Running Mate for hin own residence.

Buhari tok say di party leaders need “to sit and reason matta together,” to avoid division and ensure unity in order to avoid defeat for di coming elections

Di President tok say hin dey receive frequent reports on di ongoing campaigns for Katsina State and hin dey happy to see say di APC don put so much hard work for di campaign to work through.

President Buhari don guarantee free, fair and credible elections for di countri, just like di outcome of election for Anambra, Ekiti and Osun na big testimonies to hin administration.

Hin tok say hin dey happy and hin feel honored bi di visit and wishes wey dem show am, and hin dey wish di party a very good outcome as dey contest for di coming election.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *